fbpx
May 5, 2024

Atiku, stop to dey play Ndigbos with you old tricks — Labour Party

Labour Party don come out tok say di presidential candidate of the Peoples Democratic Party, PDP, Alhaji Atiku Abubakar dey take south-easterners for fools.

Di best way to describe wetin Atiku yarn inside one statement for Awka, Anambra State na wetin no good at all.

U FIT ALSO READ PDP dey threaten sanctions as G-5 govs go meet Tinubu for UK

Di Labour Party tok say at dis injury time, Nigerian don dey stage of dividing, base on nepotism and dominance of one particular region in government and dey yearn for unity and equity, Atiku con dey insult Ndigbo for dia home.

Labour party tok say Atiku dey ask igbo pipol to vote for ram which mean say hin wan extend di Northern-Fulani-Muslim-ticket just like di case of buhari. Wey bi like say di Ndigbo pipol never test presidency since 1999.

Di party National Vice Chairman (South East), Chief Innocent Okeke na hin yarn dis one inside one of hin statement, on Thursday.

Okeke tok say, Atiku don dey outdated. hin wan use those old political tricks on Ndigbo and dat kind thing no fit work again. dis time around di pipol of Ndigbo.

Okeke tok say southeast don wake from dia sleep and dey don readi to tell dia own future with dia own hand.

To read di full tori CLICKHERE