fbpx
April 27, 2024

Bandits kidnap DPO for Plateau

bandits-kidnap-dpo-for-plateau

Bandits kidnap DPO for Plateau. Divisional Police Officer, DPO for Pankshin Local Government Area of Plateau State don enter di hand of gunmen fit be bandits.

According to report, na on Thurday, January 12, 2023, na hin those bandits kidnap di police man wey dey popular with di name SP Lareee for WOKTORI Hotel in Pankshin.

Before di day wey these bandits kidnap di police man, hin bin don start hin posting as DPO for di area

FOR MORE NEWS: Chinese man wey k!ll hin Nigerian lover don tell court di reason

Na another policeman for di council area na hin confam this development on Thursday night. Hin yarn say na gunmen  kidnap di DPO after dem shoot am for inside hin hotel room.

Dem bin just post di DPO go Pankshin about three days ago, and hin bin dey stay  for one hotel wey dey Pankshin. As di gunmen enter, hin bin dey inside hin room.

Since that incident, nobody don see di DPO. Na wetin di police man tok be that. Na for Plateau state Bandits kidnap di DPO.

You go like read di full tori…READ MORE