fbpx
April 20, 2024

Beeko leave me, win your state for PDP, Wike tell Markafi

0

Rivers State governor, Nyesom Wike, just dey give anybody wey talk anyhow about him back-to-back. Former governor of Kaduna State, Ahmed Makarfi, wey go channels television begin dey yarn anyhow, Wike no waste time to reply him say, me and you no dey close at all at all.

According to Governor Wike, he told, na so I sit don dey watch Channels this morning, I saw one former national acting chairman of the party, PDP, Makarfi, as he dey talk say he dey very close to me.

“Somebody wey me and am dey close, ask him, when last we talk?  I never follow the man talk in the last five month, and sit don dey tell people say me and am dey close, how?

Wike yarn say e go better for Makarfi, who was the former national acting chairman of the PDP, to put his mind on the 2023 general election and how he go take win Kaduna for PDD, instead of sit don for National television begin dey lie up and down.

Na wetin Wike yarn be this for on Tuesday as him dey do the inauguration of the sand-filled area and estate layout in Ogbum-Nu-Abali, Port Harcourt, where the Governor of Enugu, Ifeanyi Ugwuanyi too dey. Click here for full tori READ MORE

 

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *