fbpx
March 29, 2024

Muhammadu Buhari – I no go put hand for 2023 elections

0
Muhammadu\Buhari

On Tuesday, President Muhammadu Buhari tell state governors wey be members of im party, APC, say im government no go put hand for the 2023 elections.

The APC governors bin visit Nigerian leader for Abuja on Tuesday and the thing wey dem talk dey inside the statement by the president’s spokesperson, Femi Adesina.

According to Mr Adesina, Mr Muhammadu Buhari tell the governors say if dem no put hand for the elections, e go comot the bad name for the political affairs. E go ensure participation and inclusiveness, and show say the governing party respect the electorate.

 

You fit also enjoy: How 2023 election go come out, by INEC.

 

The president talk say he dey impressed by the recent governorship elections for Anambra, Ekiti and Osun, where he talk say he no put hand.

APC no win the governorship elections for Anambra and Osun but win for Ekiti.

He say he want make Nigerians know say e respect them, and e wan show us say he go allow us vote who we want.

You fit read more of the tori, CLICK HERE.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *