fbpx
April 23, 2024

Belgium’s energy minister don give warning

0
Belguim's\energy\

Belgium’s energy minister don give warning say EU countries go face 5 to 10 bad cold season if dem no do anything to reduce natural gas price. EU go endure plenty bad cold season as dem no get control for the price of their natural gas. Na Beigium, the energy minister na im give this warning on sunday.

The next 5 to 10 cold season go dey very bad if dem no do anything about am. Tinne Van der Straeten bin write for twitter say dey need to act and work on the freezing gas price.

 

You fit also enjoy: Rohingya: ‘Una fit kpai us, but no send us go Myanmar’

 

Dem talk say the support for  the price control wey dey EU level don grow pass as e dey, even as the cost of  energy wey happen because of Ukraine don dey overflow.

Van der Straeten claim say e dey urgent for dem to introduce European price cap.  He talk say na im go reduce the energy bill by 77o euros per year per family.

She talk say the european energy market dey fail and e need make dem do am well well and e no dey sustain some families and company. So if they make am better, dem go fit get better gain.

You fit go read more of the tori for here, CLICK HERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *