fbpx
May 2, 2024

Nigeria digital birth, death registration platform go swallow N5.3 billion

birth-electronic-registrations

Di Infrastructure Concession Regulatory Commission (ICRC) don yarn say di N5.3 billion na hin dem go spend for di development of  Electronic Civil Registration and Vital Statistics System (eCRVS). Na platform wey go effectively keep electronic records of birth and death registrations for Nigeria.

Also, di concessionaire for di project, Messrs Barnksforte Technologies, go fund di project, while di National Population Commission go be di project grantor.

 

FOR MORE NEWS: Man City star surprise Ian Wright with hin display against Real Madrid

 

Di ICRC reveal di update inside statement issued by Mr. Ifeanyi Nwoko, di Acting Head of Media and Publicity of di Commission. Also, di statement announce di approval of di project by di Federal Government.

In addition, di ICRC yarn say di project go capture and verify births and deaths for Nigeria and provide attestation and verification of certificates to end users on di platform. According to the Commission, before now, dem dey always do di registrations manually. Also, dem see dis process as low coverage and inadequate data.

 

You fit go read di tori of di Birth and death electronic registrations…READ MORE