fbpx
April 25, 2024

Boko Haram don kill 33 wives of ISWAP fighters

0

Boko Haram terrorists don slaughter 33 wives of di rival Islamic State West Africa Province (ISWAP) for Sambisa Forest, inside Borno State.

Di slaughtering of di ISWAP wives according to report we hear say wetin trigger dis gbege bi say recently dem kill one of Boko Haram Commander, Malam Aboubakar and 15 others for one on one gun battle inside dia forest camps.

U FIT ALSO READ Rivers pastor, stepfather, teacher and others rape one orphan

Na one counter-insurgency expert for Lake Chad region, Zagazola Makama, bin disclose am for tori pipol yesterday, for Maiduguri.

Since December 3, 2022, one top Boko Haram leader in charge of Mandara Mountain for Gwoza Council, Ali Ngulde, na hin led hundreds of fighters to wage war against ISWAP inside Forest.

According to military source, for Maiduguri, di attack happun base on failed negotiation initiated by Boko Haram commanders, way bin invite ISWAP and dey tok say dey don ready to surrender to hin leadership.

Unknown to ISWAP, Ngulde and hin team don prepare ambush against dem, at least 12 pipol na hin change address go yondar for Yuwe for di gun battle. Makama tok say, others escape with gunshot wounds into di forest.

Him still tok say Boko Haram terrorist don seize four gun trucks and other weapons of ISWAP and at di same time don burn all di weapon.

Ontop how di 33 women were killed, hin tok say, “ After di victory, di Boko Haram fighters mobilize more of dia fighters from Abu Ikilima’s camp for Gaizuwa, Gabchari, Mantari, and Mallum Masari to attack ISWAP wey dey for Ukuba, Arra, Sabil Huda and Farisu,” like 23 fighters na hin kpai for dis clash.

Di ISWAP group run comot from di battle ground, na so di Boko Haram look say instead to dey run follow dem, dey con kukuma behead like 33 of dia wives.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *