fbpx
April 20, 2024

Man stab hin wife to death during argument

0

Police don arrest one 49-year-old man, wey hin name bi Lawrence Itape, becos say hin kpai hin wife with knife, wey her name bi Rebecca, during one argument over water wey hin wan take bath, for dia apartment inside Seaside Estate, Badore, Ajah area of Lagos.

Lawrence wey bi father of two pikin, according to tori, hin return home from work on Monday night and discover say water to take bath no dey di house at all.

U FIT ALSO READ One persin don kpai and di other dey hospital as Gunmen abduct corps member

Hin para give hin wife say, why she go dey house and she no fit buy water inside di empty jerricans wey dey house just like other pipol wey dey do for di community wen she know say water no dey di house.

According to tori di Edo State-born Itape order hin wife to follow am go buy water inside di jerricans, for him to bathe and drink.

On dia way going, report tok say hin wife bin branch anoda place go buy some batteries for dia wall clock wey don stop to dey work.na dis one bring anoda arguement beetwin dem again.

According to eyewitnesses, hin tok say both of dem don agree say make she no buy batteries for dat wall clock again.

Itape tok say: “During di quarrel, she bin abuse hin parents, which na normal thing whenever dem dey quarrel.

When dem reach home, she still continue to dey abusing am, sote hin vex con go carry kitchen knife take stab her 47 years old wife for neck.

Di Spokesman for di Lagos State Police Command, SP Benjamin Hudenyin, wey confirm di incident, tok say di incident bin happun around 11.30 pm on Monday.

Hin tok say “ dem don transfer di suspect to di State Criminal and Intelligence Department, SCIID, Yaba, Lagos for more investigation

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *