fbpx
March 29, 2024

BREAKING: Fire for WAEC office and another building

0
WAEC

Some workers, wey don resume for WAEC office as early as 7:30am bin dey dia office already before the fire start.

We never know wetin cause the fire, but some officials yarn say e fit be because of electricity.

Report no tey reach fire fighters about the fire for West African Examination Council (WAEC) Yaba, National Office, Lagos.

The report wey dem monitor for Lagos radio station Bond FM, yarn say firefighters from the University of Lagos (UNILAG) and Yaba College of Technology (YABATECH) don reach the office wey fire dey burn and dem don go quench the fire.

YOU GO LIKE READ: The 7-Step Customer Management Plan for Boosting Sales and Retaining Customers

One eyewitness yarn say hin see person wey look like staff of the office, as the person dey try to jump comot from the window of the 12-floor building so that hin go fit escape before hin suffocate inside.

As at that time, nobody fit reach the Council officials for more information.

The tori dey inside Daily Post…click here go read the full tori READ MORE

For more News: Fuel scarcity hold Lagos, Ogun, Abuja tight for leg

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *