fbpx
September 29, 2024

“Buhari administration waste 8 years of our lives” – Adekunle Gold

buhari-administration-waste-our-lives-adekunle-gold

Popular Nigerian singer, Adekunle Kosoko, wey dey professionally known as Adekunle Gold, don blame di current Buhari administration for al di challenges wey Nigeria dey experience.

Adekunle Gold lament for hin post for Twitter, say di President Muhammadu Buhari administration wasted eight years of di lives of Nigerians.

Hin mention say di country dey on steady regression all through di past eight years.

Meanwhile, President Muhammadu Buhari don yarn say no single government dey capable of solving all di problems wey di country dey face.

FOR MORE NEWS: “No single government go fit solve Nigeria problems” – Buhari don tok

Di president tok this one on Monday, January 30th for di  State of di Nation Dialogue organized by di Nigerian Bar Association in Abuja.

Buhari, wey bin dey  represented by di Secretary to di  Government of di Federation, Boss Mustapha, yarn say di only solution na for for successive governments to build on di foundations wey previous administrations don lay down.

According to Preident Buhari, hin tok say  no one government for this country go fit solve di problems of Nigeria but as dem build on di processes wey successive governments don lay down,dem go fit build dia dreams, take one or two things to concentrate on and move on.

 

You fit go read more of di tori…READ MORE