fbpx
May 4, 2024

Buhari don break silence on cash crunch crisis, he say na CBN, AGF dey disobey Supreme Court orders

buhari-break-silence-cash-crunch-crisis

Di Presidency don break di silence on di cash crunch crisis wey di kontri dey face for di past few weeks, following di Supreme Court Judgement wey allow di N500 and N1000 old notes to circulate side by side with di new notes till December 31.

Garba Shehu, Senior Special Assistant on Media and Publicity to di President break di silence on behalf of hin principal, on Monday, when he yarn say di Central Bank of Nigeria (CBN) no get reason to not comply with di Supreme Court Orders merely on di excuse say di president must issue directive.

Buhari still yarn say make nobody blame am at all for di current controversy over di cash crunch crisis, despite di Supreme Court judgement.

FOR MORE NEWS: BREAKING: Naira crisis: CBN don authorize use of old notes

According to di presidency, di CBN no get reason to not to abide by court orders on di excuse of waiting for directives from di President.

Shehu yarn say di presidency wish to react to some public concerns wey ysarn say President Muhammadu Buhari no react to di Supreme Court judgement on di matter of di N500 and N1,000 old currency notes.

Hin yarn say e no get time wey hin instruct di Attorney General and di CBN Governor say make dem disobey any court orders involving di government and other parties.”

Also, di presidential spokesman yarn say since di President enter office for 2015, he neva direct anybody make dem defy court orders.

You fit go read di full tori…READ MORE