fbpx
April 26, 2024

BREAKING: Naira crisis: CBN don authorize use of old notes

cbn-don-authorize-use-of-old-notes

Di Governor of Anambra State, Prof Charles Soludo confirm on Monday say di Central Bank of Nigeria CBN don authorize di use of old notes. Hin ask commercial banks make dem dispense and accept old naira notes as deposits.

Also, Soludo, a former CBN governor, make dis update known inside statement wey hin post on top hin social media handles.

He explain say di Governor of CBN, Godwin Emefiele give di directive for Banker’s Committee meeting on Sunday.

In addition to dat, hin add say Emefiele personally confirm di directive to am.

According to wetin hin tok, as CBN authorize old note, residents fit report banks wey no gree accept di old notes.

FOR MORE NEWS: CBN ends cash swap programme in rural areas

“Commercial banks dey directed by di Central Bank to dispense old currency notes.  Also to collect di same deposits from customers. Tellers for commercial banks go generate di codes for deposits, and limit no dey to di number of times wey individual or company fit make deposits.

“Di Governor of di CBN give di directive for Bankers’ Committee meeting wey dem hold on Sunday, 12th March 2023. Residents of Anambra fit accept and transact dia businesses with di old currency notes. Di (N200, N500; and N1,000) and di new notes”. Na wetin di statement tok be dat.

You fit go read di full tori…READ MORE