May 29 inauguration: Tinubu Presidency is here
Today, May 29, 2023, President, Muhammadu Buhari go pass di baton of leadership to Asiwaju Bola Ahmed Tinubu.
Nigeria find hinsef inside mixture of anticipation and unease.
As Tinubu go assume di Nigerian presidency today, anticipation, conspiracy and worry dey every where for di nation.
Di journey to Tinubu presidency no dey without challenges and controversies. And dat one make hin February 25, 2023, victory a significant milestone for di kontri political landscape.
According to report, before di June 7, 2022, presidential primaries of di All Progressives Congress (APC), Tinubu face plenty odds against hin candidacy.
FOR MORE NEWS: UK-based Nigerian lady don kpai 4 months to completion of nursing degree
Tinubu victory for di party primary election defy all odds and automatically e set di stage for di transfer of power from President Buhari.
Dis unexpected turn of events don cause both worry and excitement across di nation.
Critics argue say hin too old and hin fit no get di necessary health and vigour to effectively govern Nigeria.
Also, one of di primary contenders for di APC ticket na Vice President Yemi Osinbajo, wey enjoy popularity among party members and youth.
You fit go read di tori as Buhari go pass to Tinubu today….READ MORE