fbpx
May 18, 2024

Singer, BurnaBoy don break silence after Davido classify am as ‘new cat’

burnaboy-react-to-davido-comment

Grammy-award winning Nigerian singer, Burnaboy don react to hin colleague, Davido comment where hin classify am as “new cat.”

Di 30BG boss cause buzz on top internet on Thursday when, inside interview, hin refer to Burna Boy as new cat. Dis na term wey plenty pipo believe say e represent up-and-coming artists.

“Everybody knows that I was one of the first, along with Wizkid, to blow up. It feels good to see the new cats coming up, like Burna Boy, Rema, Fireboy, Asake, and Mayorkun,” Na wetin hin tok be dat.

Even as di “new cat” matter don spark debate about di stars for di Nigerian music industry on top social media, Burna Boy no bother.

 

FOR MORE NEWS: Why I remove fuel subsidy – Tinubu

 

Inside di buzz, Burna Boy share photos from hin record-breaking London concert on top hin Instagram page. Also, inside di caption, hin write say hin goal na to leave an impact wey go last for eternity.

“Uniting people from all walks of life has always been my dream. London, thank you for making it possible for me at my biggest show to date! Shout out to my family @theuglygram @santandave @popcaanmusic and Stormzy 🚀🔐 We’re Leaving an Impact for Eternity. Love, Damini.” He wrote.

Burnaboy post, wey fans feel say na reply to Davido “new cat” comment, don cause more reactions from fans and followers.

You fit go read di tori as Burnaboy react to Davido comment…READ MORE