fbpx
May 2, 2024

Cambodian court arrest Nigerian man and hin American partner

cambodian-court-arrest-nigerian-man

Cambodian court arrest Nigerian man and hin American partner for drug trafficking. Na on Wednesday for Cambodian court dem send dem go 25 years imprisonment.

Di charge wey dey dia head, dey under Article 40 of di Cambodian Law on Drugs Control.

Verdict say based on di evidence wey dem seize, di court find them guilty of illicit drug possession, transport and trafficking.

FOR MORE NEWS: Pastor fake kidnap for Jos, collect N600,000

As di Cambodian court arrest Nigerian man and hin American partner, dem decide to sentence di two of dem go 25 years in prison.

On top di charge, di court order di men make dem pay fine of 10,000 U.S. dollars.

 Cambodian Court still sentence another Cambodian accomplice Theam Tola, 34, go three years jail imprisonment.  Hin go pay fine of 1,000 dollars over di same case.

 Those men wey court sentence to jail yarn say dem bin wan sell di drugs because dem no get work wey dey pay dem.

Southeast Asian nation no get death sentence for illegal drug traffickers. Under dia law, anybody wey dem find guilty of trafficking more than 80 grams of illegal drugs go enter life imprisonment.

You go like go read di full tori…READ MORE