fbpx
May 2, 2024

Man enter market thief plantain – chop cane join

man-wey-enter-market-thief-plantain-chop-cane

For inside Elebele community, Ogbia Local Government Area of Bayelsa State something happen. One man enter market thief plantian, hin fin don think say better beans and plantain go set for am that day.

Hin no expect wetin hin take hin eye see for di market.

Man-thief-plantain-for-market-

 

Hin no go scot free o, na after two day wey dem catch am, hin chop better cane.

Di Community Development Committee (CDC) Chairman, Comrade Okala Precious Peter wey dem just appoint no pity di man at all.

FOR MORE NEWS: Pastor fake kidnap for Jos, collect N600,000

Hin make sure di man collect beating of hin life as hin get mind enter market go thief wetin another person suffer harvest.

Dem do this one with di hope say di man, for hin life, hin no go enter market thief plantain again. Hin no go ever forget di cane wey hin chop.

You fit like go see di source of di tori…READ MORE