fbpx
May 17, 2024

Singer, Davido react after Cheque tender public apology for ‘disrespecting’ hin wife, Chioma inside viral video

cheque-apologise-to-davido

Nigerian superstar singer, Davido, don respond after hin junior colleague, Cheque publicly apologize to am over one viral video wey e be like say hin disrespect hin wife, Chioma.

Cheque, a Nigerian singer and songwriter wey hin real name na Akanbi Bamidele Brett, a few days ago trigger heavy backlash online following one freestyle video wey hin post.

Also, as Cheque bin dey di video, hin bin dey admire Davido wife, Chioma pictures on top hin phone as hin dey sing  love song to her.
He bin scroll pass Davido and hin wife, Chioma photo. And when hin reach di picture of Chioma alone, hin zoom am kon dey sing.

Dis gesture spark controversy among fans and followers, plenty pipo yarn say as hin zoom in on Chioma picture dey sing to her e dey disrespectful.

Following di backlash, Cheque delete di video and hin use hin Twitter handle to apologize to Davido. Hin tok say hin no mean any form of disrespect.

“Never meant any form of disrespect to Davido. baba has been there for me anytime I need am, even on zoom remix. I no just just reason am well before posting. Thank you and love you big bro .. OBO”, he wrote on Twitter.

In response to Cheque public apology, Davido quote di tweet with love emoji, to show hin acceptance and forgiveness.

You fit go read di tori…READ MORE