fbpx
May 5, 2024

Child law no dey Nigeria? – Viral video matter

Shey-child-law-no-dey-nigeria-

Viral video of one young man for internet don cause serious matter for social media. Di man give hin pikin marijuana, this matter don  make pipo dey ask di question, shey child law no dey Nigeria?

As di man dey smoke hin own, hin put di marijuanna for di pikin mouth. For di background of di video, one woman dey laugh and she follow dey hype di man like say na better thing di man dey do.

Plenty social media users react to di video for Facebook.

FOR MORE NEWS: Asake 12-track album dey rank high for Billboard history

“See wetin adult dey do, tomorrow now Una go go Germany go do am when Dey imprison you, you go say na because you black.
Shey Child law no dey Nigeria”. Na wetin Chinyere write be that.

“And na di foolish mama dey laugh for di background, that one mean say she dey smoke too. Police need to arrested di parents and make dem collect that baby from them until dem get sense”. Na Canice reaction be that.

“Government need to collect that pikin from dem asap before dem cause more harm to di innocent baby”, Na wetin Obinna write be that.

You fit go read di full tori…READ MORE