fbpx
May 1, 2024

China don report di first human death wey bird flu cause

china-notify-who-of-bird-flu

China don notify di World Health Organisation WHO say one woman wey dey infected with di H3N8 bird flu die for di month of March.

According to WHO, di case na only di third known human case ever and di first to result in death from di strain. Also, di two previous cases na hin dem report for China last April and May.

For di latest incident, one 56-year-old woman from south-eastern Guangdong province die on March 16. Dis na after she fall sick in February. Also, she bin dey hospital for severe pneumonia.

Di patient bin get plenty underlying conditions. Also, she get history of exposure to live poultry before di disease start and a history of wild bird presence around her house.

As di matter be, none of her close contacts don develop di infection or symptoms of illness.

FOR MORE NEWS: Railways: FEC approve N495m to buy and install luggage scanners

Di WHO yarn say one poultry market wey near her house fit be di source of her infection.

Samples wey dem collect from di market dey positive for di influenza A(H3) subtype.

For di two previous cases, one patient develop critical illness, and di older one get mild symptoms. However, di WHO yarn say direct or indirect exposure to infected poultry fit be di origin.

Di WHO yarn say di risk to humans remain low.

You fit go read di toriof dis China bird flu…READ MORE