fbpx
May 1, 2024

UK nurses dey prepare for strike until Christmas

uk-nurses-prepare-for-strike

Nurses for Britain, UK don prepare for strike until Christmas if dem no fit reach deal with di government on pay matter. Di leader of di Kontri main nursing union tok dis one on Sunday.

Members of di Royal College of Nursing (RCN) fit go on strike at di end of April and di beginning of May before dem hold ballot. And dem go continue di strike to di end of di year, union leader Pat Cullen said.

“If that ballot is successful it will mean further strike action right up until Christmas,” Cullen tell di BBC Sunday with Laura Kuenssberg programme.

FOR MORE NEWS: BREAKING: INEC declare Adamawa guber result declaration void

Members of di union bin reject di government pay offer on Friday and immediately dem announce an escalation in strike action.

Hopes dey high say nurses for England go accept di five per cent pay offer wey dey brokered by di RCN and di government in March.

But after dem put di offer to di members, di RCN yarn say 54 per cent turn am down.

You fit go read di tori as UK nurses prepare for strike…READ MORE