fbpx
September 30, 2024

You lucky say I comot leave you – Tonto don react to di audio wey Churchill leak

churchill-don-leak-tonto-audio-recording-for-inside-social-media-

Famous Nollywood actress, Tonto Dike don react to di audio wey her her ex husband, Olakunle Churchill leak, and for inside di video, Tonto Dike yarn say she for poison if to say dem still dey together.

According to di audio recording wey Churchill leak for social media, na wetin Tonto tok be this o;

‘’See, If to say I still dey with Churchill till now, he for don kpai. I for give am rat poison. Simple as that, and I no go ever get bad  feelings or guilt. I go waka comot with ‘Oh, I am a widow’’ because e better make  I become widow.”

As di audio don reach everywhere now, Tonto Dike sef don see am, she don hear am too.

For inside her Instagram page and story, Tonto allege say Olakunle dey physically abuse her, she insist say if dem still dey together and he put hin hands on her,  e for don be hin end.

Also, she mention say Churchill na fraudster wey dey for inside di US and UK wanted list.

Di actress and Churchill dey drag dia self dor social media over dia son, King Andre.

You fit go read di full tori….READ MORE