fbpx
May 18, 2024

JUST-IN: Popular Islamic Cleric, Dr. Ismail Surty, Don Kpai For UK

cleric-ismail-surty-don-kpai

Death don carry di highly respected and global Islamic scholar, Dr. Muhammad Ibrahim Hafiz Ismail Surty, hin kpai for UK.

Inside statement wey Bashir Gwandu bring, hin describe am as a beloved father, grandfather, and esteemed teacher for Abuja on Wednesday.

Di statement yarn say Dr. Surty’s departure don leave hin loved ones and di community in deep mourning.

Also, plenty pipo bin respect Dr. Surty for his compassionate nature as a family friend to many.

Hin bin dey lead prayers for di Birmingham Central Mosque and Di University of Birmingham Mosque. In addition to dat, hin also be Professor for Birmingham University.

 

FOR MORE NEWS: JUST IN: Labour don suspend strike

 

And for Naija here, hin be di presenter of di popular TV program, ‘The Light of Islam’. Also, hin be di regular figure on top Sokoto TV during di 1980s.

Di Janazah prayer to honour Dr. Surty go take place on Thursday, August 3, 2023, around 1:45pm for di Birmingham Central Mosque, wey dey located at 180 Belgrave Middleway, United Kingdom.

Following di Janazah prayer, di burial go take place at 3:00pm for Handsworth Cemetery, wey dey located on Oxhill Rd in Handsworth, Birmingham.

Ismail Surty don kpai, You fit go see di tori…READ MORE