fbpx
May 18, 2024

Lagos Plane Crash: Investigators dey ask Pilots question

ikeja-light-aircraft-crash

Investigators from di Nigerian Safety Investigation Bureau (NSIB) don start to investigate to know wetin cause di immediate and remote crash of di light aircraft for Ikeja, Lagos on Tuesday.

Di light trainee aircraft, Jabiru J430, crash around di busy Oba Akran Avenue for Ikeja, Lagos near di Murtala Muhammed International Airport (MMIA).

Also, di turbo crop aircraft with registration number: 5N CCQ bin dey embark on test flight within Lagos when e crashe burst into flames.

However, di two occupants onboard survive di crash but dem sustain serious injury.

 

FOR MORE NEWS: JUST-IN: Popular Islamic Cleric, Dr. Ismail Surty, Don Kpai For UK

 

Di aircraft bin comot for di MMIA, Lagos when e develop fault just few minutes after takeoff and e kon descend to as low as 1,500ft.

Director-General of di bureau, Engr. Akin Olateru wey shed light on di accident for di interview wey dey monitored on Arise TV yarn say di two souls on board na qualified pilots wey dey fly aircraft for Nigeria.

Also, Olateru wey confirm say di two pilots dey respond to treatment yarn say di bureau investigators go ask dem questions to get firsthand information on wetin fit don happened.

He yarn say na thing of joy say dem survive di crash because di aircraft no dey fit with cockpit voice recorder (CVR) or Flight Data Recorders (FDR) AKA black boxes wey for help in di investigation.

Olateru yarn say di bureau go dey look into different things wey fit be di cause of di crash.

You fit go read di tori of di Ikeja light aircraft crash…READ MORE