fbpx
December 22, 2024

BREAKING: Court don strike out FG firearms charge against Emefiele

court-strike-out-firearms-charges

Di Federal High Court sitting in Lagos don strike out di illegal possession of firearms charges against di suspended Central Bank of Nigeria, CBN, Governor, Godwin Emefiele by di Federal Government.

Justice Nicholas Oweibo give di order on Thursday, following di application of Mohammed Abubakar, di Director of Public Prosecutions (DPP) for di  Ministry of Justice to withdraw di two-count charge.

Abubakar rely on Section 108 of di Administration of Criminal Justice Act (ACJA), 2015.

Emefiele counsel, J.B. Daodu bin argue say dem no fit withdraw di charge unless di government first purge dia sef of di disobedience to di court July 25 wey grant Emefiele N20 million bail.

 

FOR MORE NEWS: UNICAL don start investigation on allegation of sexual harassment against lecturer

 

For hin ruling, Justice Oweibo grant di Federal Government application, according to The Nation reports.

Also, di judge yarn say di conduct of di prosecution don show say dem no respect di rule of law.

Di Judge yarn say wetin be di benefit if dem keep di file for court docket when di prosecution don show disrespect to di court

Na so di court kon strike out di firearms charges for lack of diligent prosecution.

You fut go read di tori…READ MORE