fbpx
May 18, 2024

Dis one nah Idris no be Bob”- Reactions trail Bobrisky odd appearance for hin papa burial

bobrisky-attend-hin-papa-burial

Idris Okuneye, wey dey better known online as Bobrisky, na well-known crossdresser wey cause commotion as hin attend hin papa burial.

Di fact say di crossdresser lose hin beloved papa to di merciless grip of death no be news again.

Na in accordance with Islamic custom na hin dem bury hin papa hours after he kpai.

Also, for inside video wey don go viral, Bobrisky attend hin papa burial, and hin go undercover dress like man. Hin attendance for di burial na evidence say Bobrisky dey live fake life, and hin even lie say hin do surgery.

Hin presence for di burial disprove hin recent claim wey hin tok say hin undergo butt surgery to make am look more like woman.

Bobrisky no do hin usual glamorous look, instead, hin go for black outfit with a black scarf, wey hin use hide hin face.

Since di video come out, plenty pipo just dey troll am.

 

FOR MORE NEWS: BREAKING: Court don strike out FG firearms charge against Emefiele

 

One Leaddy Skincare write, “I don’t care about how much he dropped but I am concerned about why she didn’t dress like a female like he used to online??? Isn’t he proud of how she is making money???

One Blend Byava write, “So this is what Bobrisky looks like behind the filters. I thought he was claiming that he’s a woman now. How come he dressed like a man to his father’s burial? Where’s all the make-up and frontal them? Very shameful!!

One So Sahh write, “The fact that he has to be hiding in his father’s burial is shameful.

One Tonye Scobarrealty write, “Dey hide like bandit. Can’t even be proud of the rubbish you doing

One Meena Jayy write, “Where did they keep their boobs and bum?”.

One Thor Pebabe write, “God forgive me, he no fit even look camera

One Lady Bino write, “He’s so restless”.

You fit go read di tori…READ MORE