fbpx
May 20, 2024

UNICAL don start investigation on allegation of sexual harassment against lecturer

unical-don-start-investigation-on-allegation-of-sexual-harassment-against-lecturer

Di University of Calabar, UNICAL don start investigation into allegations of sexual harassment wey students make against Prof. Cyril Ndifon, di Dean of di Faculty of Law.

Na di students of the institution raise di allegations, and e don gain widespread attention through viral video on social media.

Inside di video, students of di Faculty of Law accuse Prof. Ndifon of sexual assault and harassment.

All di students demonstrated dis dissatisfaction with di protest wey dem stage for di office of di Vice-Chancellor, Prof. Florence Obi.

Also, during di protest, students hold placards wey bear inscriptions like “Ndifon must go for our sanity.” “We are tired of buying law journals,” and “Law girls are not your bonanza.Prof. Ndifon should stop grabbing us and others.”

 

FOR MORE NEWS: Syrian govt double workers salaries amid fuel price hike

 

In response to di allegations, Prof. Ndifon deny di accusations. Instead, hin yarn say some individuals dey within di faculty wey hold grudges against him.

Eyo Bassey, di spokesperson for di university, confirm am say di school management engage with di aggrieved parties in light of di protest.

Also, hin tok say by di end of today (Tuesday), dem go issue statement.

Yesterday (Monday), di students come out protest.

Also, as UNICAL don start investigation, Bassey yarn say di meeting with di students and faculty members lead to di discussion of different concerns apart from sexual allegations.

You fit go read di tori…READ MORE