fbpx
May 14, 2024

Tribunal turn down Atiku request for live telecast of presidential election petition proceedings

court-turn-down-atiku-request-for-live-broadcast

Di Presidential Election Petition Court, PEPC, on Monday for Abuja turn down di request by di presidential candidate of di Peoples Democratic Party, PDP, Atiku Abubakar for di live streaming of proceedings of hin petition against di election and declaration of Bola Ahmed Tinubu as winner of di last presidential election.

Also, Court yarn say di request no be something wey law support for di country for now.

Chairman of di Court, Justice Haruna Simon Tsammani, wey delivered di unanimous decision of di panel, yarn say di request no dey for di petition wey Atiku file before di Court.

Justice Tsammani follow yarn say di request fit turn di court to a stadium or market square and dem no fit allow am for now.

 

FOR MORE NEWS: BREAKING: Court don nullify Alex Otti candidature, all Labour Party candidate for Abia, Kano

 

In addition, Justice Tsammani finally yarn say di petition dey without merit and na so dem dismissed am.

Atiku bin approach di court wey dey hear hin case against di outcome of di February 25 presidential polls. Dis na so dat dem for allow live broadcast of di day to day proceedings regarding hin petition.

You fit go read di tori as Court turn down Atiku request…READ MORE