Appeal Court don put on hold arrest warrant on Amaechi, and others
One Appeal Court for Port Harcourt don warn against further action from di order of a Rivers State High Court, in criminal suit by di Rivers State Government against former Governor of di state, Rotimi Amaechi and five others.
Di State High Court handled by Justice Chiwendu Nwogu, issue warrant of arrest on May 17, 2023, against former Governor of Rivers State, Amaechi, di Governorship Candidate of di All Progressives Congress, APC, Patrick Tonye-Cole, former state Commissioner for Energy, Augustine Wokocha and three others.
When di matter resume for di Appeal Court on Friday, Counsel to Amaechi, Akin Olujimi, Senior Advocate of Nigeria, SAN, inform di court about di ruling of Justice Nwogu of di state High Court on di criminal suit, wey hin yarn say e dey in disregard of di stay of proceedings pending before di Appeal Court.
FOR MORE NEWS: Governor El-rufai sack Kaduna House of Assembly clerk and three others
Olujimi follow draw di attention of di court to an application to set aside di proceedings of di Rivers State High Court, wey dey pend before di appellate court.
Justice Ikyegh warn say make dem stop every action pending di outcome of di ruling of Appeal Court.
You fit go read di tori as Court warn against further action…READ MORE