fbpx
May 6, 2024

Africa richest man, Dangote go soon buy French club

dangote-go-soon-buy-french-club

Africa richest man, Aliko Dangote go soon buy French Ligue 2 club, Valenciennes.

According to French media outlet, Entreprendre, di business mogul, wey be di Chief Executive Officer (CEO) of Dangote Group dey ready to get 60% ownership of di club.

Di Dangote Group na di largest industrial conglomerate for Africa.

Also, di Nigerian businessman bin dey interested in buying Premier League club, Arsenal before but hin fail to achieve dat plan.

FOR MORE NEWS: May 29 transition: Wahala as Buhari govt pass N46trn debts to Tinubu

Valenciennes dey formed in 1913 and e dey play di home matches for di recently built Stade du Hainaut.

Di club don play 40 seasons for Ligue 1 and 36 seasons for Ligue 2.

Also, di Athenians neva win di Ligue 1 title but e don claim di Ligue 2 title on two occasions.

Valenciennes don follow play for di French Cup final once.

As e be now, dem occupy 15th position on top di Ligue 2 table.

You fit go read di tori see as Dangote go soon buy French club…READ MORE