fbpx
April 26, 2024

“Na church we dey o” – Davido cause commotion during service, pastor tackle members for ‘losing focus’

davido-cause-commotion-for-church

Nigerian singer, Davido Adeleke, wey also dey known as Davido, cause commotion for church members after hin enter church

Inside video wey dey upload to Instagram by @walethewave1, di superstar sit down for front row with hin team.

Along with other crew members, celebrity barman, Cubana Chief Priest follow sit down with am.

Inside di video footage, di pastor criticize di congregation for di scene wey dem make because Davido dey there.

He remind dem say na God presence dem dey , notwithstanding di presence of any personalities.

 

FOR MORE NEWS: Kizz Daniel and fiancée don call off engagement

 

“Na church we dey o, Davido come people forget say we dey church,” Na werin hin tok be dat.

Reacting to the video, Danidoofficial say: “Abi e get when him talk say him be pastor.”

Directorcruizeee write: “Service don end.”

17_morals say: “Na youth pastor.”

Moc_queen comment: “I almost run go front immediately they announced Davido was around.”

You fit go read di tori as Davido cause commotion for church…READ MORE