fbpx
May 18, 2024

Davido don bow to pressure, delete controversial music video

davido-don-bow-to-pressure

After facing heavy criticism from some Muslims on social media, afrobeat sensation, David Adeleke, wey dey known as Davido, don finally bow to pressure and hin don delete di controversial music video wey hin post on top hin page last week.

Remember say di DMW owner bin post a 45-second long video clip of hin signee, Logos Olori new song, ‘Jaye Lo,’ on Friday, July 21, promoting di song ahead of di official release.

Di video cause controversy as e portray men wey dress as praying mallams, and dem dancing in front of mosque for one scene, instead make dem dey prayer.

 

FOR MORE NEWS: ‘Fear every girl for choir’ – Nedu Wazobia

 

As a result, di scene kon dey considered offensive by some Muslims wey take to social media to criticize di artist over di development, also plenty pipo insist say make hin take down the video and apologise to hin Muslim fans.

According to report after person check Davido social media pages on Monday, dem confirm say Davido don delete di music video from hin page.

Reacting to di development, former President Buhari aide, Bashir Ahmad, hail ‘Fem’ crooner. Also hin add say, make hin no repeat dat kain thing again or any other artists.

You fit go read di tori…READ MORE