fbpx
May 18, 2024

Davido dey celebrate latest achievement amid reports wey say hin dey expect child with baby mama

davido-dey-celebrate-hin-latest-achievement

Popular Nigerian singer David Adeleke, also known as Davido, don take to social media to celebrate hin latest achievement.

Davido recently received Gold certification plaque for hin hit song ‘Fall’ for France and hin share di news with hin fans and followers on top hin Instagram page.

He post photos of himself and hin team with di plaque and hin express gratitude for di hospitality wey hin receive for Paris.

“Paris, you were amazing. I am beyond thankful for the hospitality and blessings that came! We just received a plaque for ‘Fall.’ Let’s keep it going with ‘Timeless.’” he wrote.

FOR MORE NEWS: Mercy Chinwo don hit 100m streams on Boomplay

Dis update dey comes amid rumours wey tok say hin dey expect second child with one of hin baby mamas.

Remember say di Timeless star, wey recently announce hin marriage to hin longtime girlfriend, Chioma, make headlines yesterday. Did na after controversial Instagram blogger Gistlover drop hint say one of hin baby mamas get belle for am and she go soon born.

Di blogger claim say di singer, wey get huge social media following and wey recentlymarry, dey expect another child with hin baby mama based for Atlanta.

You fit go read di tori as Davido celebrate hin latest achievement…READ MORE