fbpx
May 18, 2024

Davido pause performance to pay touching tribute to Wizkid late mama on stage

davido-tribute-to-wizkid-late-mama

Davido, di Afrobeats megastar, recently pause hin performance for di recent concert for di United States to pay tribute to di late mama of hin highly regarded colleague, Wizkid, wey hin hold in high esteem.

Wizkid mama kpai on Friday, August 18, 2023, and di terrible news put plenty of di singer followers in mourning.

Davido join plenty celebrities wey don take to social media to offer dia solidarity and sorrow to Wizkid.

Di DMW boss stop hin performance for Detroit’s Afro Nation concert to pay honor to Wizkid late mama.

Also, hin tok about hin personal experiences with grief and di global impact of Big Wiz (Wizkid).

 

FOR MORE NEWS: My ex-wife marry me only for my money” – Julius Agwu

 

Hin remember all di pipo wey hin don loose with di sad reality of death. Also, hin express hin condolences to Wizkid, and hin advise am say make hin find comfort in di fact say hin don bring joy and pride to hin late mother during her existence.

Burna follow pay heartwarming tribute to Mrs Balogun and hin yarn say hin no fit imagine losing hin own mama.

Na wetin hin tok be dis: “Before I move on, some news came to my ears not long ago. One of my brothers lost his mum, Wizkid. I want to say rest in peace to Wizkid’s mum, I can’t imagine how it would be to lose my mum, that would be the end of me.”

You fit go read di tori see Davido tribute to Wizkid late mama…READ MORE