fbpx
May 18, 2024

Singer D’Banj gift N2 million to woman inside viral $1 lottery video

dbanj-gift-trader-n2million

Nigerian singer, Oladapo Daniel Oyebanjo, wey dey known as D’Banj, don warm di hearts of plenty pipo after hin gift one trader N2million.

Everything start when D’Banj come across one trending video. For inside di video, one woman share wetin she go do if she fit win $1 lottery.

One content creator bin visit market wey dey South West, and hin ask di traders wetin dem go do with $1, equivalent to N778.

Also, as di matter be, most of dem no know di real value of $1 and dem kon dey list extravagant things wey dem go do with di amount.

 

FOR MORE NEWS: “Even Davido dey bow for Kanayo” – Reactions trail video of Davido and actor Kanayo O Kanayo

 

However, one woman catch D’Banj’s attention with her response. She yarn say she go use di money complete her building project, support her children, and expand her business.

As di response move am, di “Koko Master”, AKA D’Banj kon decide to gift di trader N2million to support her financial plans.

“Help me find this woman, I love how she wants to use her $1 WIN. I go like bless her. I wan to ‘Gbe’, D’banj tweet dis one on Monday, July 31.

You fit go read di tori…READ MORE