fbpx
May 22, 2024

Police gun down notorious robbery suspect for Delta

delta-police-robbery-suspect

Police men for Warri, Delta state don shoot robbery suspect, wey be one member of notorious robbery gang, Bobone, wey dey di area, while others escape with bullet injuries.

Di state Police spokesman, DSP Bright Edafe reveal dis tori inside statement to newsmen for Warri, also, di police operation bin dey led by di Divisional Police officer, A Division, CSP T.Y. Mahmud

“DPO ‘A’ Division Warri CSP T.Y Mahmud wey dey act on credible intelligence led operatives of ‘A’ Division Warri, hin enter di hideout of di criminal gang wey dey along stadium road Warri.

 

FOR MORE NEWS: Tinubu don change plan go london from France

 

Also di Police arrest one 58yr old suspect and dem collect one AK-47 rifle and three magazinesfor hin hand when dem start to ask am question. Di suspect confess say hin be member and armorer of di dreaded “bobone” armed robbery gang wey dey terrorize Warri and environs.

In addition, hin give di police additional information on di location of di.other gang members and hin later lead di Police to dia hideout along Chevron Road where di team on approaching the hideout, come under serious attack by hin gang members, but di suspect as hin try to escape, hin sustain serious injury for leg. Na dat one make am stop am from escaping.

Hin gang members escape with gunshot injuries, while dem carry di suspect go hospital where hin kpai as hin dey receive treatment.

Manhunt for di other gang members still dey go on.

You fit go read di tori as Delta Police robbery suspect…READ MORE