fbpx
May 18, 2024

Democracy don come to stay for Nigeria – Gov Mohammed

democracy-don-come-to-stay

Bauchi State Governor, Senator Bala Mohammed don declare say to celebrate 24th Democracy Day for Nigeria na pointer to di fact say democratic governance don come to stay for di kontri.

Di governor make di declaration known inside hin goodwill message on di occasion of di 2023 Democracy Day. Hin confirm say democracy na di best form of government wey give di pipo di right to choose who to govern dem and how dem wan dey governed.

Mohammed extend hand of friendship to those wey contested against am for di March 18 governorship election for di state, hin yarn say in di spirit of sportsmanship, dem need join hands with am in the task of taking di state to greater heights.

 

FOR MORE NEWS: Democracy Day: Emefiele policies benefit only rich pipo – Economic expert

 

Governor Mohammed yarn say di new mandate wey hin collect by di people of the state na challenge to prove say his performance during di last four years no be by chance. Also, hin give assurance say hin go prove say hin get plan to continue to work for di betterment of di socio-economic condition of di pipo of Bauchi State.

In addition, hin yarn say inclusiveness go continue to be di hallmark of hin administration, Mohammed yarn say various segments of di state go dey carried along with a view to give dem sense of belonging.

You fit go read di tori as di governor yarn say Democracy don come to stay …READ MORE