fbpx
May 3, 2024

Democracy Day: Emefiele policies benefit only rich pipo – Economic expert

expert-emefiele-monetary-policy

As Nigeria mark June 12 Democracy Day, one economic expert, Idakolo Gbolade yarn say di suspended Central Bank Of Nigeria Governor, Godwin Emefiele monetary policy only benefit di rich and e suffer di kontri economy.

Gbolade, di Chief Executive Officer of SD & D Capital Management, reveal dis tori on Monday inside interview.

According to am, Emefiele suspension as di governor of CBN na something wey dey long overdue.

 

FOR MORE NEWS: June 12: Lagos neva enjoy democracy dividends – PDP

 

Hin express displeasure about Emefiele monetary policies for di past nine years.

Gbolade yarn say di Naira redesign policy, inflation rate, legal tender management, capital investment to Nigeria and foreign exchange policies under Emefiele fail to achieve di turnaround of Nigeria economy.

Hin comment dey come amid di suspension of Emefiele by Bola Ahmed Tinubu administration on Friday evening last week.

You fit go read di tori on Expert opinion on Emefiele monetary policy …READ MORE