fbpx
December 22, 2024

“He even chose Psquare song”- Desmond Elliot don storm streets over Tinubu presidential win

desmond-elliot-tinubu-win

Actor and politician Desmond Elliot no fit contain hin joy following di win of hin preferred presidential candidate, Bola Ahmed Tinubu, as Nigeria new president-elect.

Di entertainer take to hin official Instagram page with video wey show how him and other All Progressives Congress (APC) supporters hit di streets of Lagos to celebrate dia victory.

Desmond Elliot take hin spot among di supporters wey happily wave flags of APC for air and dem sing PSquare Bunieya Enu song to celebrate Tinubu win.

“CONGRATULATIONS NAIJA RENEWED HOPE !!! JAGABAN HOPE RENEWED,” ELLIOT CAPTION DI POST FOR HIN PAGE.

FOR MORE NEWS: ‘You will never sit on this throne’- Georgina Onuoha react after INEC declare Tinubu President-Elect

See some of dia reactions below:

enibillz say: “Desmond Elliot, and Sanwo Olu, get ready to be voted out. We dey here.”

adinmasomadina write: “Of all songs dem chose p-squares bunie ya …Hmmmm I dey speechless sha.”

nnenna_blinks_ say: “Na only for film e get small sense. Real life na onye Nzuzû.”

nnenna_blinks_ write: “Since this man join politics he automatically dey unattractivè.”

emekadarlington write: “He never reason hin own winning on di 11th oo….anyway his God Father don win so pay loyalty.”

mc_daprince write: “Politics na game , one must win , e be like bet Naija either you win or you lose , Congrats to di winner but sir please make a Nigeria a better country , remove tribes and Religion . Just take us as one.”

You fit go read di full tori…READ MORE