fbpx
May 18, 2024

‘You will never sit on this throne’- Georgina Onuoha react after INEC declare Tinubu President-Elect

georgina-onuoha-react-as-INEC-declare-tinubu-as-president-elect

Actress Georgina Onuoha don react to di news of Asiwaju Bola Ahmed Tinubu wey dey declared as di winner of di 2023 presidential election. Na on 25th February INEC hold di election and na dem declare di winner.

Also, taking to her Instagram page, Georgina wey start social media fight with her colleague, Chioma Akpota over di violence wey break out during di presidential election share video of how Tinubu react to hin victory.

She yarn say hin no go sit down for di presidential throne. Also, she tag am as criminal and sham.

FOR ORE NEWS: Musa, Ebi snub Osimhen, Oshoala for FIFA awards

In addition,di mother of two even call on her creator as she mention say dem rape Nigeria as a nation and deny justice and fairness.

As Georgina Onuoha react to di news of Tinubu wey INEC declare as president-elect, she yarn say di electoral body steal di pipo mandate.

Na wetin she write be this: “You will never sit on this throne Tinubu. Lord we’ve been raped as a nation and denied justice and fairness 😮 How? This is criminal… This is a sham 😡😡😡😡 NOT my President @inecnigeria you stole our mandate.

You fit go see di full tori…READ MORE