fbpx
May 18, 2024

Presidential Election results: “E dey Truly alarming” – Uche Jombo don cry out over Tinubu victory

uche-jombo-cry-out-over-tinubu-victory

Veteran Nollywood actress, Uche Jombo don tok how she feel over di declaration of Bola Tinubu victory as di winner of di 2023 presidential election by di Independent National Electoral Commission, INEC.

Di actress dey surprise say despite video and picture evidence of alleged fraud and electoral malpractices across di country, di electoral umpire still continue with di process.

Also, pipoi bin call for di cancellation of di 2023 presidential election over di claim of wide range of rigging and suppression of di true will of di pipo by governors and politicians across di country.

However, Chairman of di Independent National Electoral Commission, INEC, Mahmood Yakubu, for di early hours of Wednesday declare di presidential candidate of di All Progressives Congress, APC, Tinubu, winner of di polls.

FOR MORE NEWS: “He even chose Psquare song”- Desmond Elliot don storm streets over Tinubu presidential win

Yakubu yarn say Tinubu polled a total of 8,794,726 to defeat hin closest rivals and candidates of di Peoples Democratic Party, PDP Atiku Abubakar and Peter Obi of di Labour Party, LP wey score 6,984, 520 and 6,101,533, respectively.

According to her, when some pipo yarn say ‘my vote doesn’t count ‘ na wetin dem mean be this. Dis one dey truly alarming.

Uche Jombo over Tinubu victory yarn say with videos and pictures of polling units across Nigeria we still dey here,” na wetin she tweet be that.

Also, she yarn say make e no discourage ANYONE. A New Nigeria dey possible as fit clearly see.”

Tinubu collect hin Certificate of Return by di INEC on Wednesday.

You fit go see di full tori…READ MORE