fbpx
December 22, 2024

“Na your mama be virgin” – Actress Destiny Etiko don breaks silence on virginity claim

destiny-etiko-deny-don-virgin-claim

Popular Nollywood actress and brand influencer, Destiny Etiko, don deny di report wey claim say she be virgin. She tok say na lie she no be virgin and she no tok anything like dat for any interview.

E neva too tey wey some reports come out. Di report tok Destiny Etiko inside interview yarn say she still be virgin at di age of 33 and she neva enter relationship wey lead to intimacy.

However, taking to her Instagram story to react inside di buzz wey di reports don stir, Destiny Etiko, inside new video deny di virgin claim. She tok say di virginity claims na lie. And she yarn say she no grant any interview on her sexual life.

On top dat one, she yarn say di pipo wey dey spread di rumours no get work, and she label dem as clout chasers.

FOR MORE NEWS: “I for cost around €150m for today transfer market” – Football legend, Jay Jay Okocha don tok

Also she answer di media personality Daddy Freeze, wey hold Instagram Live session to discuss her virginity status.

“Na your mama be virgin… What is this nonsense? I don’t get it… A lot of people are insensitive. A full-fledged man set ring light to discuss something he knows absolutely nothing about.”

“No written word or an interview about virginity and they are all busy with my precious name. That really shows how important and relevant I am.” Na wetin Destiny Etiko tok be dat.

You fit go read di tori…READ MORE