fbpx
May 18, 2024

“I for cost around €150m for today transfer market” – Football legend, Jay Jay Okocha don tok

jay-jay-okocha-cost-for-today-transfer-market

Retired Nigerian footballer and Super Eagles legend, Jay-Jay Okocha, don tok say hin for cost €150m for today transfer market.

Okocha, wey play for different clubs during hin career including Paris Saint-Germain, Bolton Wanderers, and Fenerbahce, bin dey known for hin skillful dribbling, excellent technique, and ability to score better goals.

He was also a key player for the Nigerian national team, helping them win the Africa Cup of Nations in 1994 and 2013.

FOR MORE NEWS: Kwara university teacher, Ajaigbe Issa don kpai for hin sleep

Inside an interview with Turkish newspaper Hurriyet, di 49-year-old football star Jay-Jay Okocha yarn say hin for cost €150m if to say hin still dey play for di today transfer market. He tok dis one when hin dey tok on di high fees wey clubs dey pay to buy players now.

“Maybe 1 billion should have been paid for me,” Na wetin hin tok be dat.

“They paid £106m for their defensive midfielder Chelsea. To a player from Portugal. I would have cost around €150m. My assists, dribbles… World football started to pay a lot of money. Such would be the numbers of players of this quality.

Okocha follow express his sadness as hin leave Fenerbahçe, where hin fans bin dey like.

You fit go read di tori…READ MORE