fbpx
December 22, 2024

Coup: ECOWAS don impose more sanctions on Niger

ecowas-issue-more-sanctions

Following di expired seven-day deadline wey Economic Community of West African States, ECOWAS give for Niger junta to reinstate President Mohamed Bazoum, di West African don issue more economic sanctions on Niger.

President Bola Tinubu don order fresh sanctions through di Central Bank of Nigeria on entities, and individuals wey dey related to and involved with di military junta for Niger Republic.

Di Special Adviser to di President, Media, and Public Affairs, Ajuri Ngelale reveal dis tori during press conference on Tuesday. Hin note am say these sanctions dey based on di position of financial sanctions meted out on di military junta for di Niger Republic by di Economic Community of West African States (ECOWAS) heads of states.

 

FOR MORE NEWS: BREAKING: Tinubu don set up committee on tax reforms

 

According to report, di coup plotters don name former economy minister Ali Mahaman Lamine Zeine as di kontri new prime minister.

Also, di Niger coup leaders on Tuesday vow say dem go resist external pressure to reinstate ousted President Mohamed Bazoum. Dis na na after di Economic Community of West African States (ECOWAS) impose sanctions.

You fit go read di tori see why ECOWAS issue more economic sanctions…READ MORE