EFCC don arrest 21 suspected yahoo boys for Abuja
Di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, on March 14, 2023, arrest 21 suspected internet fraudsters/yahoo boys for Abuja.
As EFCC arrest di suspected yahoo boys, di agency move di suspects and dia properties for di Lugbe and Kubwa suburbs of Abuja, following “actionable intelligence on dia allege internet-related fraud activities.”
Taking to Twitter to share di information, di EFCC reveal say “more than 25 high-end mobile phones, 3 laptops and Mercedes CLA250 and C300 cars” na hin dem recover from di suspects.
Di statement reads:
“The Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, today, March 14, 2023 arrested 21 suspected internet fraudsters.
FOR MORE NEWS: Rivers Guber: Wike na drunk, hin dey spend N50m every week on alcohol – Amaechi
Di suspects na Joseph Boniface, Emmaneul Okwara, Elijah Iwebie, Moses Hassan, Abdulrahman Lawal, Azu Chidubem Eugene, Abdullahi Adebola and Elijah Simon. Others na Terfa Lincoln, David Kome, Chukwudah Martinez, Adie Matthew, Canice Agabi, Abbas Aminu, Damilare James and Christopher Simon.
Also di ones wey dem arrest na Mohammed Abdulhamid, Ifeanyi Bosah, Ayuba Aminu, Godwin Terkura and Victor Ademola.
In addition, di EFCC person yarn say dem go dey charged to court as soon as dem conclude di investigations. E be like say as of now dem neva finish investigation.
You fit o read di full tori...READ MORE