EFCC don arrest one 21-year-old base on €17,000 fraud

Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, for Benin don arrest Irabor Kennedy Osasogie for fraud mata base on one petition wey Antje, a German citizen write againt am.
Antje wey bi di victim wey dem dupe complain give di commission say Osasogie wey bi 21 years old, don defraud her of €17,000.
U FIT ALSO READ Police don arrest armed robbers, recover stolen items for Katsina state
Di petitioner claim say she met Osasogie through social media after dem defraud her of €68,000 by one Michael Patrick.
Antje tok say Osasogie offered to assist her in recovering di money but instead hinself still defraud her of €17,000.
Inside one statement by EFCC spokesman, Wilson Uwujaren hin tok say upon di arrest, di suspect tok say na only €12,850 hin collect from her.
Hin tok say ” dem go charge di suspect go to court as soon as dey complete dia investigation.”
To read di full tori CLICKHERE