fbpx
May 8, 2024

Transfer: E go make sense to replace Ronaldo with World Cup star – Barnes tell Man Utd

Former Liverpool star, John Barnes, don come out tell Manchester United to replace Cristiano Ronaldo with World Cup star, Cody Gakpo.

According to Barnes, hìn tok say e go make sense if Man United fit sign Gakpo as Ronaldo replacement for Stamford Bridge.

U FIT ALSO READ Aguero don identify four Argentina World Cup stars wey go succeed Messi

Gakpo bin play very impressive football for Netherland during di 2022 FIFA World Cup for Qatar.

Di PSV star score like three goals from five appearances to help hin countri get through to di last-eight stage.

Ronaldo, like dis like dis na free agent hin bi after Manchester United don terminate hin contract last month.

Barnes tell BonusCodeBets say “ hin think say a move for Gakpo go make sense well well for Manchester United.”

Hin tok say “Gakpo go get more playing time for Manchester United dan Liverpool and hin go fit for Man U dan Liverpool . base on say Gakpo na goal threat wey dey work hard for di team.”

To read di full tori CLICKHERE