fbpx
May 18, 2024

Elon Musk don remove Davido, Wizkid, Burna Boy, and others verification badges

elon-musk-don-remove-badge

Microblogging site, Twitter don remove badge, Legacy verification tick. on top di account of notable Nigerian musicians.

Di microblogging platform, on Thursday, remove di verification badges of di Nigerian singers, Burna Boy, Davido, Wizkid and Peter Okoye.

Remember say di Twitter owner, Elon Musk bin drop hint. In March, hin post tweet wey dey accompanied with links to subscribe to di premium program.  Also, hin yarn say hin get plans to commercialize verification tick. And now, Twitter don remove pipo badge.

 

FOR MORE NEWS: Sabinus don reveal hin net worth

 

According to am, hin go begin to wind down di legacy verified program and hin go remove legacy verified checkmarks on di 1st of April. And To keep di blue checkmark, individuals fit sign up for Twitter Blue.”

Also, as hin announce di final date for di free Blue badge removal on top hin verified Twitter handle, Elon Musk write: “Final date for removing legacy Blue checks is 4/20.”

Di removal of di Legacy Blue Tick of di Nigerian superstars fit dey connected to di non-payment of dia verification subscription fee wey Musk don announce.

Reacting to hin Blue Tick removal, inside tweet on Friday, Peter Okoye yarn say, ”Elon Musk na business man period.”

You fit go read di tori …READ MORE