fbpx
April 25, 2024

End-EFCC-Protest-for-Delta: Three-person don kpai, 20 trucks burn down for Ughelli

0

Serious kasala don burst for Delta as End EFCC protest don make three person change address go yonda, as if say that one n reach, the angry boys for the area vex put fire for more than 20 trucks wey dey carry petroleum product and granite.

According to report wey we hear so, those wey kpai on top this matter na youth wey still dey in their 20s.

People wey dey the area talk say the youth dey vex on top the wey EFCC dey burst dem for the area left, right and Centre. Na wetin make the angry youth barricade the Otovwodo axis of the East/West Road wey make it difficult for motor to past the area.

One protester, wey him name na Johnson talk say, “We want peace for Nigeria but the wey EFCC dey terrorize us be like say dem just dey find mean to disorganize us from voting for 2023 general election and we no go gree.

Another protester, wey him name na Christian, shook mouth for the matter, he yarn say, we no get road, we no get job, student dey strike, still EFCC still no let dem rest.

You fit still enjoy this article: Tips to Maintain a Good Relationship with Your Customers

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *