fbpx
April 20, 2024

EndSARS: Two years after, Oyo police station still be like abandon property

0
Oyo-police-station-burned-by-robbers-during-ENDSARS-protest-

One of di days wey di pipo of Ogungbade, Kukumoda, Aba Igbira, Amero, Papa and Adeji no go forget fast fast na di Friday, 23rd October, 2020, for ENDSARS time.

That day still be day wey di pipo of di community go remember, as na di day wey some criminals demolish di project wey dem contribute money do.

Di community dey along di new Ife/Ibadan Expressway for Egbeda Local Government Area of Ibadan, di Oyo State capital.

Na that day dem burn down Ogungbade Police Station, di only police station wey dey serve more than thirty (30) communities for di local government area.

Di police station na just about one kilometre to di new Ife/Ibadan expressway.

E neva too tey wey dem do investigation for di communities. Di investigation show say di landlords for di communities bin don invest dia money to take build di police station so that e go fit reduce di rate of armed robbery for di areas.

Di tin wey di people want don spoil like this, as di criminals take advantage of ENDSARS protests put fire for di police station on Friday, 23rd October 2020….READ MORE

NBA go assist members wey flood affect

 

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *