fbpx
May 9, 2024

Enugu govt go raise LG funds by 60 per cent

enugu-go-raise-fund-for-projects

Di Government of Enugu State yarn say dem go raise fund for development projects by local government councils for di state to di tune of 60 per cent to speed up grassroots development, especially for di areas of agriculture, agro-allied industrialisation and critical infrastructure.

Na after meeting of di Enugu State Economic Planning Commission for di Government House, Enugu, on Monday, na hin di government tok dis one. Dem yarn say di move target na to boost di rural economy and to create jobs for di teeming youths.

After di meeting wey di council chairmen attend, di Secretary to di State Government, Prof. Chidiebere Onyia address di Government House correspondents, hin yarn say di Mbah administration want progressive partnership with di local governments by providing marching funds for selected projects wey align to di economic agenda of di state government.

 

FOR MORE NEWS: 100 days in office: Tinubu policies don divide financial experts

 

Also, di SSG yarn say one key agenda of di decision na to open up rural areas to economic development activities for di area of agriculture and agro-allied industrialisation and to encourage agro-allied processing zones and a land bank of 300,000 hectares for commercial farming.

Meanwhile, di Chairman of di Association of Local Governments of Nigeria (ALGON) Enugu State chapter, Hon. Sydney Okechukwu Edeh, wey commend di Governor Mbah administration for di counterpart funding, yarn say partnership with di state government go help with di funding of priority projects wey go touch di lives of pipo. Also, di fund wey Enugu govt go raise for di projects go promote transparency, accountability and traceability for di management of local government funds by di council areas.

You fit go read di tori…READ MORE